Odumosu Don Deny Say Dem Appoint Am As EFCC Chairman.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di retired Assistant Inspector General of Police (AIG) Hakeem Odumosu don deny news wey tok say dem appoint am as di substantive Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

E don dey for many platform say Presido appiont Odumosu to chairman di anti-graft agency.

But one tori wey com out on Wednesday say na Odumosu write am and di tori kon tok say  'Good Morning everyone, I have been inundated with so many calls and messages between yesterday and today on a purported "EFCC Appointment", I just want to use this opportunity to debunk this information  and say it's totally UNTRUE.'

E kon later add say di informat, say na Mischief Makers form di fake news make pepo nor regard di informat at all.

Presido bin don suspend di EFCC Chairman, Abdulrasheed Bawa last week.  Presido kon tell Abdulkarim Chukkol make eim take over di leadership as di acting leader of di anti-graft.

How una see dis mata???
#Chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C