On Air Now

Evening Oyoyo

8:00pm - Midnight

No Just Dey Social Media Dey Tok, Come Collect Una 20Million PVC's For Our Hand- INEC Dey Shout

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The Independent National Electoral Commission chest don dey beat up and down because dem dey fear for the 2023 elections, as dem dey look say dem still get 20 million Permanent Voters Cards wey pipu neva come collect.

This one make dem come dey shout say  plenti pipu no even do continuous voters’ registration exercise.

INEC’s Deputy Director (Voter Education), Mary Nkem, tok say “This CVR exercise don start since June 30 2021; but we don see say since that time go reach now, the pipu wey don go register still no plenti.

She tok come tok say "If youths wey dey this country go come out as dem plenti cast dia votes, we no go dey record 15 or 20 per cent voter turnout for our elections, because we know say the population of the youths alone fit change everi thing.


“INEC no dey do election ontop social media and we no dey count ballots wey dey ontop Twitter or Instagram. Dis na wetin INEC tok


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 24°C