Nigerian Army Tok Say Dem No Dey Plan To Take Over Nigeria

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Nigerian military don tok say na lie say some military officers get meeting with one of di Presidential candidate, so dat dem go fit scatter di 2023 General Election.

Di persin wey dey act as di Director of Defence Information, Brigadier General Tukur Gusau tok for one report wey he give on Saturday say di Armed Forces of Nigeria no happy about dis report at all.

He tok say, he dey disappointed say somebody wey dey inside and know politics well go fit “bring deir self so low” come join “pipo wey dey scatter di country” to dey lie and cause wahala for inside we country wey be Nigeria.

“We need make pipo know say di Armed Forces of Nigeria na qualified military wey dey loyal to di constitution of di Federal Republic of Nigeria and dem no go ever join anybody wey plan to stop di country democracy''.

General Gusau still tok say di military pipo no dey do politics and dem no dey support anybody for all dis political waka wey dey happen so.

As him tok, our country security pipo go call dose pipo wey dey cook dis lies and misinformation dey spread give Nigerians, to come explain demselves and proof of everything wey dem dey tell pipo.

Him dey advise di pipo of Nigeria, say make dem no mind di lies and make dem continue with deir normal lives and things wey dem dey do.

Di last time wey military government rule Nigerian pipo na for 1999 and since dat time, di country dey do democracy.

The February 25 Presidential Election wey dey waka come so, na di seventh Presidential Election since 1999.

#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C