Ngige Don Wear Eim Cap Ready To Run For Presido Chair

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The number of pipu wey dey contest for presido chair for inside the All Progressives Congress (APC) don dey swell up like garri wey dem soak forget, As oga Dr. Chris Ngige don where eim cap to join the waka

The minister of Labour and Employment wey also be before governor of Anambra state, tok this one on Tuesday, for  St. Mary’s Catholic Church wey dey eim  hometown for Alor inside Anambra State.

Dr. Ngige tell eim pipu wey gather to come show am love, say eim don wear eim canvas, tight eim belt, and wear eim cap. to join the waka to become presido of we obodo naija.

 

Eim also tell oga Muhammadu Buhari, thank you oooo. Because eim allow am serve as a minister for eim government. Oga Ngige don be senator and governor before eim come be minister for this government.

 

Oga Ngige also be the second  minister for President Buhari cabinet wey don come out come tok say dem wan join the waka to become presido. The other minister na Oga Rotimi Amaechi, wey be the Minister of Transportation.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C