NDLEA Catch Lipstick Wey Dem Pack With Drugs for Lagos Airport

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don seize another set of female lipstick wey dem use hide illegal drugs for Murtala Muhammed International Airport, Lagos.

Di agency Director of Media and Advocacy, Femi Babafemi, yarn this one for im X (wey before na Twitter) page on Sunday. E still warn Nigerians, especially women, make dem shine eye well-well before dem buy or collect any cosmetic product — especially from people wey dem no sabi or online sellers wey no clear.

For di statement, e talk say:
“Ladies, make una shine eye! E be like say dem don dey use female lipstick hide drugs now, as NDLEA officers don catch another set of factory-fitted lipstick wey dem use pack illegal substances for MMIA. This one na just few days after we see similar package for one courier company for Lagos.”

WATCH VIDEO HERE


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C