Meeting Between FG and Labour no Get Head on top Fuel Subsidy Removal Mata.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di meeting between FG and Nigeria Labor Congress (NLC)on top fuel subsidies on Wednesday evening no get head.

Di Nigeria Labour Congress(NLC) no gree for di new pump price wey di Nigerian National Petroleum Corporation Limited(NNPCL).

Di oga for tok tok for NNPC Ltd, Garba Deen Muhammad tok say di new price of fuel na becos of di wey tins don be now becos of fuel subsidy mata.

But NLC presido, Comrade Joe Ajaero tok say dis one na ambush wey dem do dem because dem no go fit tok to FG becos of dis one wey NNPC do.

Dis meeting happen for Presidential Villa for Abuja and di meeting dey fro more than 5 hours.

Di representative of Federal Government, Dele Alake don tok say dem go still dey tok together to make sure say dem agree after dia next meeting. 
   
How una see di mata
#chookmouth  


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C