LASTMA Record 69 Deaths, 246 Injuries For Lagos Road Crash Q1 2026

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

LASTMA talk say no less than 69 people don die for road accident for Lagos between January and March 2026.

Dem still report say 246 other people get different levels of injury for di same period, showing say road safety still dey serious concern for di state.

LASTMA General Manager, Olalekan Bakare-Oki, talk dis one for interview for Lagos. Eim say di agency respond to over 600 accident scenes within di first quarter.

According to am, dem also tighten enforcement work and settle over 900 cases wey involve trucks and big vehicles.

Eim add say LASTMA carry out about 4,900 enforcement operations and also record 17,942 traffic offences through technology systems.

Bakare-Oki warn say dem no dey joke with traffic law at all, and any vehicle wey dem impound go face mobile court quick.

Eim still talk say dem dey work to make traffic flow better and reduce delay on road through better planning and equipment.

Eim say LASTMA don upgrade their tools and recovery vehicles and position dem well to respond faster to accident cases.

On training, eim talk say dem don start year-long programme to train over 1,000 officers.

Eim add say dem bring consultants join to improve special training, and more capacity building go still happen soon.

Di update show say government still dey try reduce accident and improve road safety for Lagos.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 40°C | Low: 22°C