LASTMA Go Begin Arrest Transport Bus Wey No Get Government Colour

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Lagos Traffic Management Authority go begin arrest buses wey no get Lagos State black and yellow color wey dey carry passengers.

LASTMA General Manager, Bolaji Oreagba, tok for statement say e dey warn all commercial bus drivers make dem paint dia buses yellow with black or red lines or Government go hold dia buses. 

He also tok say make dem paint all Korope buses yellow with black lines and all those buses with two doors make dem paint am wit di approved red colour. 

He say dem dey do dis sake of say dem wan protect di lives and property of Lagos residents. 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 43°C | Low: 26°C