Lagos Island Flooding Wahala Go Soon End- Gov Sanwo Olu

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Lagos state Governor, Babajide Sanwo-Olu tok say the wahala of flooding for Lagos Island go soon be wetin we no go fit dey remember again. As dem go soon solve the mata finally wen with the construction of big gutter for Ilubirin area of the state.

Governor Sanwo-Olu tok dis one wen eim come chook eye for some project wey dem dey do for inside Lagos Island.

The place wey some of the project wey eim come chook eye ontop na Cappa/Okepopo Adeniji-Adele Road, the New Massey Children's Hospital, Renovation of General Hospital, Odan, and the laying of three high-capacity pumps at the Ilubirin drainage site.


According to Oga Sanwo-Olu eim say dem start this dia waka for the reconstruction of Cappa/Okepopo & Adeniji-Adele Road in Lagos Island.

“The contractor tok say the project dey 60-65 percent. And dem go fit complete the project before the end of the year.

Eim still tok say ontop mata of the Ilubirin pumping site

Since Lagos na city wey dey below sea level and when the water increase for Lagoon, e make come back inside the city".

Na why dem dey build this pumping site to help commot the water and stop flooding. And next month high-capacity pumps go land for the state.

Oga Sanwo-olu yarn say with everi everi wey dem dey do to stop the mata, We go soon tell flooding for inside Lagos Island bye bye.
 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 19°C