Lagos Government List Alternative Routes as Kara Bridge Go Close

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Lagos State Government don announce alternative routes ahead of the partial closure of Kara Bridge.

Motorists wey dey go Opic and Mowe, dem dey advise make dem plan their waka well well during the two-week repair period.

One way na make dem enter from Third Mainland Bridge go Ketu, then go Mile 12, join Ogolonto reach Ikorodu Garage, come continue through Sabo Roundabout go Isagamu Road or Itokin Road.

Another way na make motorists wey dey Lagos Island pass through Ilubinrin go Ijora Bridge, then enter Eko Bridge go Funsho Williams Avenue, join Ikorodu Road reach Ojota, come continue through Ketu and Mile 12 go Ikorodu Garage.

Commuters fit also start from Ikorodu Garage, go through Sabo Roundabout reach Ogijo, come pass Likosi and Shimawa go Lotto before dem head Mowe.

Lagos State Traffic Management Authority talk say officials and traffic signs go dey along the affected road to guide motorists.

Authorities dey urge all road users make dem give extra travel time and follow traffic direction to reduce wahala for road.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 17°C