'JAPA': House Of Reps Nor Gree Chook Mouth For Di Mata Wey Concern Nigerians Wey Dey Comot Go Other Countries.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The House of Representatives don say lielie dem no go chook mouth for di "JAPA SYNDROME" wey Nigerians dey comot go other countries wey to find greener pastures.

Na Representative Philip Agbese(APC-Benue) Wey carry di mata com put on top di table for di house of rep. He con carry statistics wey eim collect from Nigerian Economic Summit, di document con reveal say di rate wey young Nigerians dey run comot go other countries dey shocking.

E kon still tok say according to di report wey Africa Polling Institute get,over 69% of young pepo go japa comot go other countries if dem get di chance.

E kon still tok  say, United Nations Department Of Economic and Social Affairs(DESA) don confam say dem notice 40% increase for di number of young pepo wey don japa comot from obodo Nigeria compare to di way dem japa comot for 2019.

Agbese con still chook mouth say di way young Nigerians dey secure permanent residence for di abroad fit cause serious wahala to di Nation's Economic among many wahala wey dis mata fit cause di country.


Di House Of Representative  Speaker, Wey eim name na Tajudeen Abass con say make dem vote if dem wan chook mouth for di matter. As NAN report, di lawmakers wey dey di House Of Reps con open mouth tok say dem no wan address di matter wey concern Nigerians wey dey japa go other countries.


How una see dis mata???
#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C