INEC Don Release Lists of Candidates for November Elections.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

INEC Release List for Governorship Election for Kogi, Bayelsa, and Imo States.

Di Independent National Elctoral Commission don release di final list of governorship election wey go happen for November 11 for Kogi, Bayelsa and Imo states. Di Approval of di list bin happen afta one meeting wey happen on Tuesday for Abuja.

INEC national Commissioner and chairman of informate and Voter Education Committee, Mr. Festus Okoye sign one statement wey confirm say na 18 political parties candidates for Kogi, 17 for Bayelsa, and 16 for Imo states.

Two political parties get female candidates for Bayelsa, one for Kogi,and none for Imo.

Di List don dey on top INEC website and social media pages.

INEC still tok say campaign go start officially on Wednesday, 14th June and go end 9th November, 2023.

How una see di mata?
#chookmouth 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 43°C | Low: 26°C