INEC Chairman Don Swear In 19 New Resident Electoral Commissioner.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Independent National Electoral Commission don swear in 19 chacha Resident Electoral Commissioner dem enter office.

Di Chairman for INEC, Professor Mahmood Yakubu na eim swear dis 19 pipo dem enter office for di INEC headquarters for inside Abuja on Thursday .

Di Oga for INEC come dey tell dis new RECs wey dem appoint say make dem put for mind di integrity of di commission. Eim remember dem say dia loyalty na first to Naija pipo dem before any oda thing and make dem no disappoint Naija pipo dem.

Fourteen of the commissioner dem na new member and di remaining four na old member for inside di commission .

How U See Di Mata? #chookmouth
 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C