Guinness World Records Don Carry Biro Confirm Di Record Wey Hilda Baci Attempt

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Guinness world records don talk say one Nigerian woman ,don break di record of di longest cooking marathon by one pesin.

Guiness World Records don com out for dia confirm page for twitter talk say "After we don confirm say for footage wey we get, we dey happy to announce say Hilda Baci na di record breaker for the longest cooking marathon by one pesin."

Hilda wey be 26 years old don break the record, eim cook for 93hours 11minutes com get di longest cooking marathon record.

The former record wey one Indian chef wey eim name na Lata Tondon do reach 87hours 45minutes for 2019.

The Nigerian chef,Hilda baci be start on thursday 11 may to monday 15th may and she bin cook about 100 pots of different food.

She be set to break di record with 100 hours,but dem remove 7 hours from di 100 hours becuase she do mistake take extra minutes from one of di breaks when she first start di attempt.

She don com out talk her mind for the mata say "I also decided to break this record to truly push my limits and test my abilities".

How una see di mata?
#chookmouth 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C