On Air Now

Evening Oyoyo

8:00pm - Midnight

Governor Fubara Don Dash Rivers Hoopers ₦100m, Coaster Bus & Hilux Van

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Fubara talk say wetin make dis cup special no be just to win di league, but to win am seven times

Di Governor of Rivers State, Sir Siminalayi Fubara, don sama Rivers Hoopers Basketball Team with ₦100 million Naira, one coaster bus and one Hilux moto, as dem win Nigerian Basketball Premier League title for di seventh time.

Governor Fubara announce dis one on Thursday inside chop chop meeting to Jolificate with di team inside Government House, Port Harcourt.

Di governor come deh clap hand for di players for dis win, as him say na discipline, hard work and correct sabiness weh make dem continue to win cup.

Fubara talk say wetin make dis cup special no be just to win di league, but to win am seven times, and all of dem happen under him tenure.

Di governor assure di team say dem go receive di coaster bus between Friday and Monday to help solve dia waka waka kpalava.

Una remember say Rivers Hoopers win di league title for September after dem finish di Final Four Playoffs and dem no loose any of three matches.

Dis victory na di seventh domestic league championship for di Kings Men, na dem still hold di record after dem win di title for 2011, 2012, 2019, 2021, 2023 and 2024.

Like dis now Rivers Hoopers go represent Nigeria for di next edition of di Basketball Africa League (BAL).

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 16°C