Germany Don Return Benin Bronze Wey Dem Bin Thief

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Germany don officially return 22 Benin Bronze wey dem bin collect from Nigeria.

Germany foreign minister, Annalena Baerbock don return di bronzes to di Minister of Information and Culture, Lai Mohammed, for one ceremony for Abuja on Tuesday.

She say e dey bad of British Colonialist to thief dem and later sell am to different museums around di world.

''Today, we dey here to return  di Benin Bronze to where dey belong to originally, to di people of Nigeria'', Baerbock tok.

''We dey here to correct di bad wey bin happen''.

Lai Mohammed wey collect di Bronze wey dem bin thief on behalf of di Nigerian government praise di German authorities.

''Twenty years ago, or even Ten years ago, nobody go believe say these Bronzes wey dem bin thief go return to Nigeria, because di wahala wey dey to collect am back dey clearly impossible,'' Alhaji Mohammed tok.

''But Today, with dis starting move of a friendly nation, Germany, di story don change.''

Dem bin thief di bronzes for 1897 during di Britian's attack for di old Benin Kingdom during dat time wey dem cummot di Oba of Benin, Oba Ovonramwen Nogbaisi, from di throne.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 42°C | Low: 22°C