Gbajabiamila Don Resign Comot From House Of Reps

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Femi Gbajabiamila wey bin dey di house of rep as the speaker don come out say e nor dey do again, say e don resign.

He say e dey comot because e wan start di new work wey dem assign am to, di  work dem give am na to be di new Chief of Staff to our new presido, President Bola Ahmed Tinubu.

Dem assign di new position give am on di 2nd of june and e suppose start e new duties on Tuesday 15th of june.


E don be member of di house of rep for 20 years and e don be speaker from 2019 reach 2023.

Before den sef, e don serve as di minority leader, di minority whip, and di majority leader.

How una see dis mata??
#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C