Gas Explosion Don Injure Four For Inside Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

One man and three women don injure well well afta one gas explosion for Agege area of Lagos State.

One report by di Lagos State Emergency Management Agency(LASEMA) tok say one gas cylinder explode becos of gas leakage and e catch fire wey still catch the shops wey near wey di gas for explode.

According to LASEMA, dem fit stop the fire before e burn pass as e don burn.

LASEMA's Permanent Secretary, Dr. Femi Oke-Osayintolu, still tok say di pipo wey injure, dem don carry dem go hopspital for treatment.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C