Fuel scarcity: NNPC Dey Tell Nigerians Say Dem Dey Sorry

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

And dey dey promise Nigeria pipo say dem go settle everything in one week time.

 Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited don come out to tok say dem dey sorry for di suffer wey Nigeria pipo face for dis fuel matter wey no dey.
Di Oga patapata of NNPCL, wey be Mele Kyari, tok dis for one tok tok wey he do with Channels Television’s special election programme The 2023 Verdict on Tuesday, 7th of February.

He promise di pipo say dem go settle dis ''wahala'', di way wey everybody go dey happy. 

“I dey sorry for all dis wahala. And as di persin wey come tok for all of us, all di pipo wey dey di oil and gas business. For sure, we go solve am. Even though, e dey very sad. Na small wahala and na our work to solve am. We go solve am,” he tok.

When dem ask am say when him feel like say everything to change patapata and Nigerians go start to see turnaround, Kyari tok say, he strongly belief say everything go dey alright in di ''next one week''.

#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C