Election Palava: Obi Dey Mourn Di Pipo Wey Die For Di Saturday Governorship Election

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di presidential candidate of Labour Party, Peter Obi, tok say him dey very sad to hear about di pipo wey die on Saturday when dem dey do di governorship and state house of assembly elections.

Plenty pipo report say, dem attack dem and dem no gree make dem vote deir own person for almost everywhere wey di elections happen on Saturday.

For one tweet wey Peter Obi tweet on Sunday morning, him wish everibody wey wound for di elections say make dem get well soon.

Him tweet tok say: ''With sadness, my heart dey go deeply to di Nigerians wey die and di ones wey wound just because dem come out, come do a simple thing like voting for election. I dey pray for dem and I pray make di ones wey wound, well fast,'' he tok.

I dey send my support to di family of di pipo we die. Make God Almighty give dem forever rest and make God give deir family di heart to take dis loss wey dem no go fit replace.

''And I honestly pray make God Almighty help and save Nigeria out of dis dangerous situation.''

#chookmouth 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 24°C