Eid-el-Kabir: FG Don Declare Wednesday and Thursday As Public Holiday

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Federal Government don declare Wednesday and Thursday wey bi di June 28th and 29th of june 2023 as public holiday for dis year Eid-el-Kabir.

Na di Permanent Secretary of di Ministry of Interior na eim com out make dis announcement say - 
For di spirit of dis ogbonge period say make we observe di good behavior of obedience, sacrifice and faith wey Prophet Ibrahim being teach during eim time. E kon tok  all muslims and nigerians suppose make sacrifices for di growth and development of obodo nigeria.


E kon still tok say, E dey hopeful say dis all di prayers and sacrifices wey com wit dis ogbonge season say e go bring about peace, unity abd progress in obodo nigeria. Na wetin e tok for dis mata. 


How una see dis mata??
#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C