DSS Don Arrest Di Pipo Wey Plan Di Kogi Palace Bomb Blast

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Department of State Services (DSS) don arrest di pipo wey plan di bomb blast for Kogi State near di Palace of Ohinoyi of Ebiraland for Okene wey happen on di 29 of December 2022.

The Vechicle-Borne Improvised Explosive Device (VBIED) blow before President Muhammadu Buhari reach di state for him official visit.

DSS Public Relation Officer, wey be Peter Afunaya tok on Wednesday say di pipo wey do dis one na Abdulmumin Ibrahim Otaru (aka Abu Mikdad) and him partner wey be Saidu Suleiman.

Him tok say dem arrest dem on di 3 of January and as Otaru dey try run, dem shoot am for him left leg to stop am. And him dey hospital dey collect treatment like dis.

DSS tok tok person still tok say Otaru dey lead plenty criminal gang inside Kogi State and him gang dey kidnap pipo for Kogi and even Ondo State.

Di criminal dey police pipo hand and very soon dem go face justice.

Di DSS pipo dey tok say anybody wey get correct information wey go fit help us secure our country, Nigeria, to come forward, so we go fit maintain a peaceful country.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C