DSS Dey Warn About Terrorist Attacks For Sallah Festivities

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Department of State Services (DSS) on Thursday warn Nigerians of terrorists’ attacks as dem wan celebrate Eid-el-Kabir dis period.

Tok tok pesin of di join bodi, Dr Peter Afunanya come out tok say dem don get reports say plans dey to attack place wey pipo dey gather worship and places wey pipo dey go relax dis period wey eid-el-Kabir celebrations dey.

According to di man, dis reports dey come afta dem recover Improvised Explosive Devices(IEDs) from pipo wey dem suspect as terrorists wey dem do join together operation by di department and eim sister security join bodi.

He still tok say di department raid some criminal hideouts for Kogi and Nasarawa states on Monday and dem do dis one with Nigerin Army and Nigerian Police Force.


He don tell operators and patrons of public places, including markets and malls say make dem dey watchful and make dem report any suspicious movements and pepo give security agencies immediately dem notice am.


Afunanya don tok say di DSS go continue to partner wit their Co-security agencies so dem go fit com up wit better proactive drills wey go fit frustrate criminals and their activities. (NAN) 

How una see di mata?
#chookmouth
 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C