Democracy Day: Highlights From Tinubu Speech.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

President Tinubu don Promise to ease di pains of di petrol subsidy removal.

Today na Democracy Day for Naija and na still National public holiday. Democracy Day na eim mark di day wey military give power to civilian wey di pipo elect for 1999. 
Democracy Day before na May 29 until former Presido,  Buhari declare June 12 as di new Democracy Day. 

Presido Tinubu bin give eim first Democrcy Day speech. 
For eim message, di president tok say him see all di suffer and hardship wey naija pipo dey face since fuel subsidy don comot. Na dis one make am come promise say eim go make sure eim go "reward" dia sacrifices with "massive investment" for inside  transportation mata , education, regular light, and healthcare.

President Tinubu still tok say him administration no go gree for any illegal orders wey go undermine Nigeria democracy. He still tok say dabill wey him sign for June 8 on top retirement age fro judiciary na one of di many policy reforms wey go happen for dis administration.

Di activities wey suppose happen today wey be Democracy Day go dey low key becos of di way wey dis  administration wan dye cut down cost, na di Secretary to di Government of di Federation, Senator George Akume tell tok tok pipo dis one.

Afta di nationwide broadcast ,di Presido go inspect military parade for di State House foyer.  


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 26°C