Dem Neva Sack Inspector General of Police

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Nigeria Police Force don tok say Federal High Court for Awka no sack IGP of Police.

For weekend, di tori of say one Federal High court for Awka binn don order di sack of di IG. 

Di Court bin order say make di IG,Usman Alkali Baba to comot for di office of IG as eim don reach di age of 60years for March, 2023 as na eim be trh age of retirement as e dey for our constitution. 

For one statement wey di Public Relations Office of Police, Muyiwa Adejobi tok say di IGP get right to appeal di judgement and say news wey pipo dey carry up and down say na lie, no body don sack IGP.

Oga Muyiwa still tok say IGP Alkali enta office for 30th November, 2021 and na 4 year tenure and dat 4 years never reach. 

How una see am ?

#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C