Cubana Chief Priest Blame Elders After Im APC Primary Defeat

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Celebrity businessman and socialite Pascal Okechukwu, wey people sabi as Cubana Chief Priest, don lose im bid to secure di All Progressives Congress (APC) ticket for Orsu/Orlu/Oru East Federal Constituency ahead of di 2027 general elections.

Di APC House of Representatives primary election hold on Saturday as part of preparations for di 2027 polls, but Cubana Chief Priest score only 14 votes for di exercise.

Di nightlife promoter and Imo State Coordinator of di City Boy Movement bin contest under APC platform, but delegates reject im ambition during di party primaries.

Before di election, Cubana Chief Priest post for im Instagram page say e still dey consult stakeholders and pray for victory.

“Still Consulting, CP neva sleep. Hia na di last lap of my consultation. Hoping for di best as we fight to finish,” im write.

After di result come out, social media users begin react, especially because di celebrity businessman openly support President Bola Tinubu and di current APC administration.

For one video wey dey circulate online, Cubana Chief Priest express disappointment over di outcome of di election and blame community elders for im defeat.

“I’m a hustler and I no regret say I try contest for position. My only regret na trusting di elders for di community.

“I know how much I give dem, but only 14 people vote for me for di primary,” e tok.

Meanwhile, APC also disqualify several aspirants across different states from participating for di House of Representatives primaries.

For statement wey National Publicity Secretary of di party, Felix Morka, release on Saturday, di party tok say although some aspirants pass screening, dem no clear dem to participate for di primaries.

Di party no give specific reasons for di disqualification, but tok say di screening committees follow APC guidelines and procedures to determine who qualify.

Some of di affected aspirants include former lawmakers and political figures from Ondo, Bauchi, Ebonyi, Kogi and Rivers states.

For Rivers State, some aspirants wey get links to suspended Governor Siminalayi Fubara camp no make di final clearance list.

Di APC primaries go determine di candidates wey go fly di party flag for di 2027 general elections across federal constituencies nationwide.

Comments

Add a comment

Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 41°C | Low: 24°C