Court Don Order DSS to Give Emefiele Access to eim Lawyers and Family

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

One Federal High Court wey dey Abuja don give immediate order to di Department of State Services (DSS) to grant di Governor of the Central Bank of Nigeria (CBN) wey dem suspend, Godwin Emefiele, all access to eim lawyers and family members as na eim constitutional rights.

Justice Hamza Muazu na eim grant dis order afta di application wey di counsel to Emefiele, J.B. Daudu SAN apply.

Daudu bin tell di court say him bin don send diffrent letters to di DSS, especially di one of June 14, say him wan talk to Emefiele but di DSS no answer am.

Remember say na DSS arrest Emefiele on Saturday, some hours afta Presido Bola Tinubu suspend am on Friday.

How una see di mata?
#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C