Civil Defence, Immigration Board Don Release Shortlist for Employment Test

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di jambody of internal security outfits when dem dey call Civil Defence, Correctional, Fire and Immigration Services Board (CDCFIB) don announce say dem don release names of people wey dem shortlist for di ongoing recruitment.

People wey apply for Nigerian Correctional Service, Nigeria Immigration Service, Federal Fire Service and Nigeria Security and Civil Defence Corps suppose visit di official website recruitment.cdcfib.gov.ng from Thursday, October 30, to check whether their name dey.

Di announcement wey carry di signature of CDCFIB Secretary, Maj. Gen. A.M. Jibril (Rtd.) talk say anybody wey see im name for di shortlist go also see venue, date and time for di Computer-Based Test (CBT) for di portal.

Di Board warn make applicants use only di official website and make dem shine their eye against scammers wey dey pose as recruitment agents.

According to dem, dis step mark di next stage for di recruitment process for di four security and emergency agencies under di Ministry of Interior.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 17°C