CBN Don Lift Limits on Domiciliary Accounts

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Di Central Bank of Nigeria don lift di limits wey dem put on top domiciliary accounts.

Domiciliary account holders don dey allowed to deposit as dem like , still get all access to funds wey dey di accounts , and withdraw up to $10,000 daily.

Na CBN release di statement on Sunday.

Di CBN still tok say Nigerians don get free hand to access Investors and Exporters Window.

"All visible an dinvisible transactions(medicals, school fees,BTA/PTA , airline , and oda bill payment) don dey allowed on di I&E window", na so di statement tok.

CBN's Director of Corporate Communications,Isa AbdulMumin tok say dis new one na to boost di market confidence and to make sure say everybodi dey see wetin dey happen for di foreign exchange market.

Dis one bin come out afta tok tok for di extraordinary Bankers' Committee meeting wey happen on Friday 16th June. 

How una see di mata?
#chookmouth


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 26°C