Buhari Don Approve Di Plan Wey CBN Get To Redesign Di Naira Note.

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

President Muhammadu Buhari don announce say eim support dey wit Central Bank Of Nigeria ontop dia plan to redesign and replace some of di naira note dem .

According to di tori wey di Media person for Mr President,Garba Shehu, eim tok say President Buhari dey ok wit di explanation wey CBN give am about di plan to redesign some of di naira note to help reduce fake naira note,inflation and to help spread plenty cash inside di cointry.

Eim yarn dis one for di interview wit one Hausa Language radio staion and say dem go show di interview on Wednesdsay morning for Tambari TV ontop Nilesat.

Di CBN Governor,Godwin Emefiele wey bin don announce him plan to redesign di N100, N200, N500 and N1000 note dem,tok say di new note go dey everywhere by December 2022 and dis oda notes dem no go get value again by Janaury 31 2023.

 

How U See Di Mata? #lchookmouth 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 43°C | Low: 24°C