Applicants Nor Dey Satisfied Over Rivers State Civil Service Commision Online Screening

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Some applicants wey dey find work for di Rivers Civil Service Commission tok say di online screening test wey di Commission set up get alot of technical wahala.

Dem con tok say di whole 4 minutes wey dey bin give dem, dem use am load di 10 questions.

Some of dem still tok say di 2-day window nor dey okay at all say make di state government extend di date make pepo wey bin nor do because of di wahala go fit do their own.

Some applicants con still chook mouth  say, di website bin nor dey go through, say make dem increase di days say two days nor dey enough.


'Nor be say i nor know di answers but i nor finish because i bin nor fit access di 10 questions before di portal be log me out,'one applicant tok

'Make dem extend di date, na d only way dem go fit help pepo wey nor write' he con still chook mouth put.


Former governor, Nyesom Wike on di 13th of March don swear in board members of Rivers State Service Commission under di chairmanship of Clifford Ndu-Walter wey tok say dem must employ 10,000 youths for inside one month.

The mata neva dey complete, for more dan 3 months wey dey talk dis mata.

The applicants get hope say di governor wey dey office now, Siminialaye Fubara, go fit complete di employment process wey e promise wen e be dey do campaign.

How una see di mata???
#Chookmouth 


 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C