Akpabio Don Become Senate President

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Dem don elect Senator Godswill Akpabio of di All Progressive Congress as President of di Senate.

Na Senator Godswill Akapabio win for di election wey tight against eim Zamfara West opponent, Abdulaziz Yari.

Before di contest,na Senator Ali Ndume nominate Akpabio while na Senator Elisha Abbo nominate Yari.

Yari nomination bin no go well with Senator Tahir Mungono as eim tok say Yari ominatin no follow constitution.

Wetin Mungono tok come make quarell burst for front of clerk for National Assembly, Sani Magaji wey bin preside over di session dissmiss wetin Mungono tok say eim go only rely on Order 3 of di Senate Standing Rules to elect di President of di Senate.

Afta di election, Senator Akpabio na eim win with 63 votes while Yari get 45 and one person no vote.


How una see di mata?
#chookmouthh  
 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 44°C | Low: 25°C