2023 Presidential Election: LP Go Fight “Electoral Injustice” –Datti Baba-Ahmed

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

The vice-presidential candidate of the Labour Party (LP), Datti Baba-Ahmed, don ask party’s supporters to dey peaceful and patient as di party go carry out legal action on the just concluded election.

Ontop one news briefing on Wednesday, him tok say dem rig last Saturday’s presidential vote.

“We sabi say the result wey dem gada announce no dey clear at all; e no dey free and fair" na wetin him tok.

“To add to di attacks wey happen, voter intimidation, all di rules and guidelines wey INEC promise for dis election, we no see anything.

Baba-Ahmed don vow say LP go drag di result of the presidential election.

“Make una no say we ready to fight the wayo wey dey do Naija pipu with legal and peaceful means,” na wetin him yarn for di briefing.

“E dey painful but make una remain calm as our fight for new Nigeria just dey start.

“We dey ginger una to continue with di campaigns and vote wella for Labour Party for di governorship election and the state house of assembly elections on 11th March 2023.”

The LP vice-presidential candidate tok say him principal, Peter Obi will speak about the presidential election soon.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C