2023: CBN Dey Tell INEC Say Dis Moni Wahala No Go Stop Election

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Central Bank of Nigeria (CBN) dey promise Independent National Electoral Commission (INEC) say e go arrange di moni wey dem go need for any wahala for dis General Election wey dey waka come.

Godwin Emefiele wey be CBN governor promise INEC chairman, Mahmood Yakubu, dis one on Tuesday when him go visit am for him office wey dey Abuja.

Professor Yakubu tell Emefiele say dis new moni wey no dey fit affect vote. Dis one na becos INEC dey pay some sellers with cash for emergency work for dat election day and dis new moni wey no dey and di weekly withdrawal limit wey be N5 million fit stop di whole thing. He beg CBN say make dem chook eyes for di matter to show deir support.

 ''Nigerian election dey very big and hard. So, we go need emergency workers and we go still need security pipo and na transfer we dey use pay dem,” Professor Yakubu tok.

But, we still get important things like transportation and human support services wey we need to sort out fast, whether half or full becos dem don dey work.

“To add to all dis one, quick quick matter fit happen wey go need make we pay with cash as soon as e happen. Some of dis quick quick workers no dey use bank.”

Mr. Emefiele promise INEC say di oga patapata of all di banks for Nigeria go do everything wey dem fit do to support di 2023 election.

Dis issue of how to pay and plan for di for pipo wey go carry election things, even to go di place; di promise wey I dey give you na becos we know say INEC work dey very important as na matter wey concern we nation, e no fit fail and central bank no go allow make dem use dem or make dem see dem as pipo wey no gree make di election come out well,'' he promise. He still remind Professor Yakubu of how CBN don bin dey show support for di election waka. 

I know say few months ago, when I bin come your office, you tok about how we go fit get obodoyibo moni to take buy di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) and other election things wey we need to bring enter di country. And I promise you say, we go arrange di naira wey we go use change to obodoyibo moni for dis reason.

 “I stand here and I sit down here to tell una today say, we no dey owe $1.  We don arrange all di dollars wey we need to take buy dis things from obodoyibo and all di things wey we buy don dey we country,” Emefiele tok join.

 CBN and INEC get close working relationship, dem dey keep deir money with CBN and di oga patapata of all banks for Nigeria dey also help INEC’s keep deir election things and dey go send am go di places wey INEC tell dem to send am go when di election start.

#chookmouth 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 20°C