U-20 AFCON 2023 : Flying Eagles lose first group game to Senegal

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Senegal kpokpo di Flying Eagles one kondo as Nigeria start di tournament on a disappointing note

Flying Eagles dey rock bottom of Group A with zero points after di 1-0 loss to di Junior Teranga Lions, Senegal.

Di superb run of 17 unbeaten matches don finally end as Senegal striker Souleymane Faye smash rebound ball from Nigeria goalkeeper into di roof of di net just before half-time. Nigeria bin get good chances for first half but no bin fit convert am to goal. 

Senegal dominate second half but no bin fit score. For stoppage time, Ahmed Abdullahi collect second yellow card as Nigeria finish di match with 10 men.

Egypt and Mozambique, di other teams for di group play goaless draw as dem share 1 points each.

Next up for Flying Eagles na Egypt (the hosts) for di second Group A fixture

Di tournament wey dey shele for inside Egypt get other teams like Congo, Tunisa and Zambia. 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C