John Mikel Obi, di former Nigerian midfielder don retire from football

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

After over 18 years of play, di player wey be one of di most decorated for Nigeria don retire after a successful career.

If dem mention di name Mikel Obi, plenty things go dey di minds of football fans depending on age and or location.

Plenty Nigerians go remember am as Super Eagles captain wey carri Nigeria go win di AFCON in 2013. Some go also remember am for di FIFA world youth championship wey eim captain Nigeria to silver as Lionel Messi Argentina bin kpakuka di trophy.

Football fans for Europe go remember am for di world class display for di 2012 Champions League final wey Chelsea bin eventually win.

Mikel no too score plenty goals for eim career but wetin eim achieve during di over 18 years of active play go put am among di very best players wey Africa don ever produce. Di Super Eagles player win every possible trophy for Chelsea except di World Club Cup.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 43°C | Low: 22°C