Chelsea don sack Thomas Tuchel after 100 games in charge of di Blues

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Thomas Tuchel Chelsea team so far dis season don perform below expectations for a side wey dey lead for teams wey don spend pass last summer transfer window.

Chelsea make dis announcement officially for their website as dem thank Tuchel for him time and di fact say him win trophies for di club say dem no go ever forget Tuchel.

Tori wey dey on ground (via Sky Sport) be say Graham Potter, di current Brighton coach wey dey show confam workings for inside EPL with Brighton dis season dey likely to take over from Tuchel.

E dey clear say di new owners of Chelsea get serious winning mentality because na only 6 matches Tuchel manage dis season before dem sack am.

Anyway, di sacking culture no dey very new for Chelsea. Infact di only 2 times wey Chelsea don kpakuka di UEFA Champions League, na managers wey dem bring come after season don start helep dem win di trophy including Tuchel himself.

 


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 42°C | Low: 23°C