Anthony Joshua go fight Oleksandr Usyk this Saturday, 20th August 2022

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

''I go knack am akpako'' - AJ

Anthony Joshua go fight Oleksandr Usyk this Saturday, 20th August 2022 for Saudi Arabia.

For sidon tok with Sky Sports, eim tok say eim don learn Usyk tactics & tricks.

Di last time wey dis top boxers meet,a year ago, Usyk bin beat Joshua for di Tottenham Hotspur stadium and now eim go wan defend the WBA, WBO and IBF championship belts, with Joshua, as di challenger.

Di English boxer go soon celebrate him 33rd birthday but age no be problem for am because from him sidon tok with Sky Sports, him no dey admit any signs of slowing down, say na rush eim go rush Usyk for inside ring.

Whether di tactics wey him don learn and di tricks go helep am defeat Yusik, na wettin we go wait see on Saturday.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny

    High: 42°C | Low: 21°C