You fit allow your pikin marry woman wey don divorce?

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Society and pipu don place label ontop women wey don divorce and most times e dey hard for dem to get acceptance. pipu no even wan care about wetin make you divorce

Ontop #Trutalk wit @chiboiwazobiafm x @adakuchineme, dem tok about why Women dey quick to badmouth their fellow women wey don divorce or separate from their husbands.

E dey hard for Society to accept dem and most Women no go eva gree make their Sons marry woman wey don divorce or separate.

You go gree make your Pikin marry Woman wey don divorce? #Chookmouth tell us for comment section.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C