On Air Now

Area Mata

Noon - 3:00pm

Shey Kayanmata Dey Really Work ?

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Back in the day for northern Nigeria, wen woman marry. As dem dey go dia husband house. dia mama go give dem some herbal concoction wey dem go take, so that dem go fit satisfy dia husband. this na how kayanmata take start.

Kayanmata na hausa word, wey mean for english "women's things" and the work of the herbal portion na to make pipu wey dey use so that dem go fit enjoy dem self wen dem dey make love.

But many young girls nowadays don dey use kayanmata for another thing wey no be wetin dem originally make am for. to the extent say dem don dey add juju to the mata, so that dem go fit catch men wey go fit dey give them plenty money.

One of the biggest influencer for ontop this kayanmata waka na Hauwa Saidu Mohammed and na she get Jaruma empire. Jaruma empire dey sell different type of kayanmata product, from portions to chocolate and even beads sef. 

Plenti young girls know jaruma products because, she dey use popular influencers to take promote her products ontop social media, and other women wey don use the product dey also share dia testimony.

But report come out  for news say popular Nigerian billionaira, Ned Nwoko. Arrest the kanyanmata business woman. this one come make pipu dey scratch dia head. because the Billionaira wife Regina Daniel Nwoko, and Jaruma na friends. And Regina dey also promote jaruma products.

This whole drama come make Chiboi, come dey ask for inside #TrueTalk for #Kulelezone. Shey this kayanmata really dey work? and shey e even dey legal to use kayanmaka to take catch man?

tell us wetin you think about this mata? 


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 22°C