Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, talk say dem go open Opebi-Mende-Ojota Link Bridge for public before Christmas, as work on the bridge don reach about 80 per cent.
Governor Sanwo-Olu give di assurance during inspection of di project. Him admit say construction don pass di September deadline wey dem first set to complete am.
Him talk say him visit di site to check how work dey go and find out wetin cause di delay. But him stress say dem no go compromise di engineering design and safety standards of di project.
Sanwo-Olu explain say di bridge work involve installation of more than 300 tonnes of steel for height wey reach 25 metres, wey make am serious engineering work.
Him say dem don complete three out of di four major steel parts wey dem design to look like cane wey dem weave together. Work still dey go on for di last section.
Di governor add say dem go install light wey get di colours of Lagos State to make di bridge fine well-well.
Other work, including cleaning di site, repainting road kerbs, landscaping and fixing areas wey construction affect, go also finish before dem open di bridge to public.
Sanwo-Olu insist say di state government no go sacrifice quality of engineering work and public safety just to meet di deadline.
Him also express hope say di area go become place wey people fit visit for recreation, cultural heritage and tourism, as e go reflect di history and identity of di community.
Dem start construction of di bridge for 2022 as part of Lagos State Government infrastructure projects to reduce traffic congestion for Opebi, Mobolaji Bank Anthony Way, Mende and Ojota road corridor.
Comments
Add a comment