On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Lagos 2027: Sanwo-Olu Don Dey Support Hamzat! to Take Over for Alausa

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Governor Babajide Sanwo-Olu don officially tell the world say na him Deputy, Dr. Obafemi Hamzat, he want make he succeed am for the 2027 governorship election.

Monday, April 27, after one closed-door meeting for Lagos House, Marina. As Hamzat declare him mind say he wan run, all the APC "shakers and movers" dey there—including the GAC elders, Speaker Mudashiru Obasa, and other party bigwigs.

Governor Sanwo-Olu talk say the reason why he support Hamzat na because the man sabi the work well-well and he go make sure say all the better-better projects wey dem start no stop.

The Governor talk say: “We all agree say the Deputy Governor fit, he ready, and he well-marinated for this work.” He even hail President Bola Tinubu say the Jagaban don see this vision since eight years ago, and now the thing don manifest.
 

Before this big announcement, e be like say Hamzat don go do him "home-work" well-well. He don visit many big men, including the President Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, wey also give am "green light" say Lagos go dey "safe hands" under Hamzat.

Even the Renewed Hope Labourers Network (Lagos chapter) and other youth groups don already begin blow trumpet for Hamzat, say make him and President Tinubu (for second term) just work together so that the "reforms" go continue to flow for state and federal level.


Abuja Weather

  • Abuja

    Thunder storm

    High: 31°C | Low: 21°C