On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

Kogi State Ban To Wear Facemask and Selling Bodi Business

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Kogi state Governor, Yahaya Bello don tok say eim no wan see pipu dey wear facemask for the state again so that dem go fit know who be who wey dey inside the state.

The governor tok this one for inside townhall meeting wey eim do with all first and second-class traditional rulers, plus local government council chairmen in the state on tuesday for Lokoja.

the townhall meeting wey happen because of the way security mata take dey for the state. 

Oga Bello, tell all the traditional rulers for the state say make dem shine dia eye wella, wella for dia area. Even all the koro wey dia area make dem chook eye still for does place to make sure say gbege pipu no dey hide dia.

Eim still tok for that meeting say make all the place wey dey do selling bodi businesss, close dia shop kia kia before eim close and open eim eye.

Governor Bello come tell Local Government Chairmen, union leaders, and security agencies make dem join bodi with the State Commissioner for Local Government and Chieftaincy Affairs. to fit make sure say all the Keke and okada pipu for the state get the correct paper wey dem need to take work for the state.
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 23°C