On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Kaduna Train Attack: Video Show Pipu Wey Dem Kidnap Dey Beg Govt For Help

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

The terrorist wey attack and kidnap pipu for inside train wey dey go from Abuja to Kaduna don release video wey show the pipu wey dem kidnap inside forest.

 the video clip wey HumAngle drop, show 10 terrorists wey carry gun dey stand for the back of the pipu wey dem kidnap wey come siddon for ground for open space. 

The Video come show four women wey stand for front of the camera, and one of dem tok say she be student of Kaduna State University. And she say her name na Lois John.

According to wetin she tok, she say “I dey tok on behalf of the students. Government abeg mak una come help us,” 

Anoda woman, wey say her name na Gladys, and she be  ex-staff of Defence Industries Corporation of Nigeria tok say, “Wetin happen on Monday (28 March) no suppose happen if for say Govt been dey listen to wetin pipu been dey tell dem…”

 

She no complete her tok before the change to anoda four men, wey the Managing Director at the Bank of Agriculture, Alwan Ali-Hassan. Follow inside. Wey mean say dem shoot the video before dem release oga Ali-Hassan, on 6 April.

As e be like this Seven pipu naim don die, and about 170 others naim dem kidnap. 

 

With the way wey tins be e be like say dem wan to use the hostages take negotiate for the release of some of dia fighters wey  dey government detention centres.

 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C