Former Presido Jonathan, Hail Everybody Wey Win Ticket To Drag Presido Chair

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

Former presido don come tell all the people way win the ticket to take drag presido chair for inside the different polical party congratulobia.

Na eim tok tok person Ikechukwu Eze naim help am do this one on thurday.

Eim hail  Peter Obi of the Labour Party (LP), Atiku Abubakar of the Peoples Democratic Party (PDP), and Bola Tinubu of the All Progressives Congress as dem be the people wey go drag presido chair for dia party.

Oga Jonathan also hail Rabiu Kwankwaso of the New Nigeria Peoples Party (NNPP), Ibrahim Malik-Addo of the Young Progressives Party (YPP), Dan Nwanyanwu of Zenith Labour Party (ZLP), Dumebi Kachikwu of African Democratic Congress (ADC) and Adewole Adebayo of the Social Democratic Party (SDP).

The Former presido come even yarn dem say, make dem no just they dey yab dem self for dia campaign oo. When dem climb stage go campaign, make dem tok about wetin dem go do to make naija beta.

Eim even say make dem go dey use dia campaign waka come dey divide and spoil Naija more more. Make dem no take because dem wan be presido come dey let people dey kpia ontop dia mata. 

Oga Jonathan come say make everybody wey know say dem want make Naija beta, come out for election day make dem vote. And make  Independent National Electoral Commission (INEC) and security agencies no do anything wey go break law.


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C