On Air Now

Evening Oyoyo

7:00pm - 11:00pm

Barber Kolet Six Months Free Rent Inside Prison Because Eim Thief Canopy

You are viewing content from Wazobia FM Abuja. Would you like to make this your preferred location?

One Area court for jos don arrange self contain inside prison for one barber wey eim name na Moses Tobi because eim go thief canopy.

The magistrate dem dash Tobi this sentence after eim agree say yes my lord i kolobi the canopy. But dem come tell am say, if you no wan go this place wey we arrange for you. You go pay N10,000 fine.

Dem report the case for 14th May, After Tobi waka enter person fish stand, come move the person canopy wey if you press calculator e go show you say the price na N30,000

No be only Tobi mata dem chook eye for inside eim mata sha. Anoda 24 years old man, Yakubu Musa, Kolet 12month free rent inside prison because eim go break the padlock wey dey person shop door after the person close shop for jos.

The two Oga for court wey chook eye and mouth for the mata, Ghazali Adam and Hyacinth Dolnanan. Afta dem look the mata finish, dem come ask Musa Shey you do am abi you no do am?

Musa come tok say My lord i do am, abeg make una forgive me.

Naim the two oga for court come am say you go pay N20,000 fine, but if you no fit pay wey go arrange bed for you for inside prison wey you go stay dia relax for one year.

The Police person wey they push the mata talk say the police station wey dem report the mata na Laranto Police Station, Jos on 14 February.
 


Abuja Weather

  • Abuja

    Sunny intervals

    High: 37°C | Low: 24°C