On Air Now

Satide Waka

10:00am - 2:00pm

Tinubu Don Tok Say Make Ministers and Oda Govt Official Dem No Go Obodo Oyibo Anyhow Again

Presido Bola Tinubu don ban ministers, Oga of agencies, and oda government officials say make dem no use government moni go outside kontri again.

Tinubu give di Order for di letter wey im Chief of Staff wey bi Femi Gbajabiamila, write give George Akume wey bi di Secretary of Government of di Federation.

Tinubu still tok say any government official wey wan go obodo oyibo for any mata wey go need government moni must to collect permission 2 weeks before e go di travel and say di mata must serious.

Gbajabiamila tok say Tinubu give di command sake of say di  moni wey dey enta on top di travel mata too plenti.

Im tok say wit di way economy dey for we kontri dem wan try manage government money wey dem go dey spend.

Di ban for on top di travel mata wey go last for three months, go start wella for April 1 2024.


 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C