On Air Now

Satide Jolli

6:00am - 10:00am

SSANU And NASU Don Tok Say Dem No Go Work Until FG Pay Dem

Di Senior Staff Association of Nigerian Universities (SSANU) and di Non-Academic Staff Union (NASU) don go on strike wey go affect all university for we kontri bcos of di salary wey Federal Government no gree pay dem


Oga kpatakpata of SSANU, Mohammed Ibrahim, and Peters Adeyemi, wey bi NASU secretari tok say dem start di 7 days strike on Monday, as warning wey dem dey give government say make dem settle dia salari mata.

Di salary wey government no gree pay na bcos of di ‘No Work, No Pay policy’ wey di former President Muhammadu Buhari put bcos of di eight months and four months strike wey ASUU and SSANU bin get for 2022.


Di Joint Action Committee (JAC) of di two union dey para for the government say why dem go pay ASUU salary but dem no gree pay NASU dem own. Di SSANU President even tok say Vice Chancellors, registrars and bursars neva see dia arrears salari collect.

Di Oga of Nigeria Labour Congress, Joe Ajaero, don tok say eim no see any beta reason wey make Federal Government no gree pay, and say make dem Kia Kia pay di four months salary wey dem dey owe Senior Staff Association of Nigerian Universities and Non-Academic Staff Union so dat dis mata go end 


SSANU and NASU don close hostels dem and even off light for plenti university for di kontri now for two days.

As e be so, di strike don dey affect school work.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C