On Air Now

Satide Waka

10:00am - 2:00pm

Adaora Umeoji Don Become Zenith Bank First Female GMD/CEO.

Adaora Umeorji don become Oga kpatakpata (GMD/CEO) for Zenith Bank PLC,na she be di first woman to Sidon for di seat.

According to di tori wey come out on Tuesday, Central Bank of Nigeria don approve di position for Dr Umeorji and e go start from June 1, 2024.

Na she take over from Dr. Ebenezer Onyeagwu, who dey complete him time of five years on 31 May, 2024.
Di way wey dem take select am, na from di way wey dem take dey do things, to make people for inside the bank to grow, na so di bank tok.

Before dem put Dr Umeorji for dis position, na she be Deputy Managing Director for di bank since 28 October, 2016 and she don get 30 experience and she don use 28 years for di bank.


She don complete Advanced Management Program for Harvard business school, she get certificate for Global banking program for Colombia Business school.
She get Bachelor degree for sociology, University of Jos, Bachelor degree for Accounting, first class honours for Law Base University, Abuja.

Plus, she get Master of Law from University of Salford, United Kingdom and Masters in Business Administration (MBA) from  University of Calabar.
 

How u see di mata? chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C