On Air Now

Music

Midnight - 6:00am

Port Harcourt Girl, Anita Johnny Don Get Chance To Break Guinness World Record

She tok say she never fix the date wey she go take break this record yet

Guinness World Records don sama approval for 72-hours Slice-a-thon give one Miss Anita Chinyere Johnny wey from Nkpogwu for Rivers state, for inside we kontri, Nigeria.

For inside "As e dey hot" with Sisi Boma for Wazobia FM, PH; Miss Anita tok say she go cut veggies and fruits for 72 hours to take break the slice-a-thon record wey one Indian man bin do since 2018 for 24 hours.

She com tok say she go give the veggies and fruits wey she go slice during the slice-a-thon to people for free to take appreciate dem as dey come out to support her.

She tok say she never fix the date wey she go take break this record  yet as she dey try to arrange things dem wey she go need to use during the sliceaton but say this sliceaton go happen for inside this April wey we wan enter so.

She dey call on the people of Rivers state, restaurants/fast foods, and the Rivers state Government to come press hand support this this record-breaking as e be say this one go bring out the name of we Rivers people for good.

Wazobia FM, and our sister dem, Nigeria Info and Cool FM Don join bodi with Anita already.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 27°C